Friday 14 March 2008

::deep thuts provoked::

what happened to all my bloggers ehn..everyone has gone private..na wa ooo....i hope everyone is ok sha..

well...ive jus bn chillin oo...sum dulln days..sum serious dreamin days..but sha na so life give am to us o.. i have small gist o...oya sit don make una hear word o..

so na so b the cast o..
Crush: Ikechukwu
New Friend: Taisha

oya let me start...
see eh..Ikechukwu is dis fine bobo i jus come dey eye like dis...o...as in the bobo is foine...but u kno foine boys always have one thing or the other...sha we were sha bubblin as in chilln.u kno gettn to kno...meanwhile me i don do my research well well o...(girls hav to check na)..so him history no good o...but nonetheless i figure na one life o...les jus see how it goes.
Ikechukwu likes to form o as in boy no go call two days in a row ..n u kno as naija babe now...i do my own too..but i no last long o..sha we don dey yarn more now..as in when bobo hit town ..hin dey buzz me as hin dey land..na so he talk ooo..BUTTTTTTTT

NOW yawa come break...seee i come fin dis babe..ehn...we gel o...(that one na real comodity) sha we dey hang..n bobo name come up..na so d babe yarn me say hin think bobo b my bro..as in..warrahel...wich kin sister n bro u see like dat.hiss...u kno babes dey use style get jist sha me too come spice am well well...na so d babe dey browse my phone o ...(naija babes dey try for quarvn o) sha me sef i no dey keep jist for fone o..u neva kno wetin go shele...so sha babes kon buzz bobo up ...na so dey de yarn o...as in i was like see my life....na man do dis to gewls ooo...sha i dust am...abi hin no do me nurrn...if i want bobo i go take m o but bobo no rich dat kind level yet...

so sha na so tis two babes...dey crush bobo o..n bobo think he get brain abi...hin go seee us( as in me n taisha) n go dey pull me like hin wan marry me..when i no gree am hin do dey text taisha ..can u imagine....n taisha go dey do long tins to get bobo attn...na wa o.....

una....wetin woman go do....as dey talk m o! as in...babes before man shey..but dis babe b like sey she get k'leg o....wetin woman go do!

meanwhile toaster #3...don serious o..as in we don dey yarn as if i no get bills sha...hin kon dey deni girlfy as in serious denial...meanwhile..i trust my sources...i go catch d truv o...as in babes r not ready to deal wiv dis kin stuvs....o...

abegie..we go jam again oo...

3 comments:

Anonymous said...

lol drama much...Ik must be feeling like a bigger boy with himself

Omosewa

flawsandall said...

your pidgin na dis sha..lol

yeah ol'boy head they big say girls dey trip for am..I cant stand fine boys...I need me a nice worwor boy who will cater to my needs

Chari said...

babe...totally loving ur bloggins...ahahn gat d@ 9ja flav...